Welcome To aBlackWeb

Boko Haram attack: Rice farmers decapitation 'massacre' for Borno, village burial vex Nigeria social media users

DOS_patos

Unverified Legion of Trill member
29 November 2020
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

WIA DIS FOTO COME FROM,TWITTER/@DAWISU
Borno Rice farmers murder village victims of suspected Boko Haram attack enta six feet on Sunday afta di dem suffer slaughter [decapitation] during di attack near Maiduguri, Borno state northeast Nigeria.
At least 110 civilians na im dem kill and many odas wound inside one attack on farmers for northeast Nigeria.
UN resident and Humanitarian coordinator Edward Kallon, reveal dis tori for statement on Sunday.
Tori be say attackers cut throats of dis rice farmers wey only go find wetin to chop for dia agriculture fields inside northeastern Nigeria.
Earlier BBC Pidgin bin report say na 43 rice farmers dem kill but Zabarmari villagers for Borno say dem no fit tok di exact number of pipo wey di suspected Boko Haram attackers slaugter for di rice farm.
Now, Nigeria social media dey catch fire on top di killing of dis rice farmers wey dey dia farms dey harvest rice on Saturday.
On Saturday, di militants attack di farmers wey bin dey harvest rice farm for Zabarmari, Mafa local goment.
Govnor Babagana Zulum lead di burial prayers for forty three farmers wey Boko Haram militants kill on Saturday. Residents say nobody still fit tok exactly how many pipo die for di attack.
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

WIA DIS FOTO COME FROM,BORNO STATE GOVERNMENT HOUSE
Tok tok pesin for di community tell Govnor Babagana Umara Zulum,wey lead di burial of di farmers say, as tins be now nobody still fit tok exactly how many pipo die for di attack.
According to Amnesty International, inside di pipo wey die, 10 na women wey dem neva sabi who dem be, wey bin dey wordk for di rice farm, while sixteen of dem na refugees.
Boko Haram attack: Borno Rice farmers murder, village victims of decapitation

WIA DIS FOTO COME FROM,BORNO STATE GOVERNMENT HOUSE
Wetin pipo dey tok
Boko Haram killing of innocent pipo don dey go on for more dan 10 years, but in recent times Nigerians as well as pipo from around di world don dey tok more and more about about di mata as e be like say di killing no get ending.
While some pipo dey blame Buhari goment for doing rehabilitation programme and releasing many of di militants unto say dem don "repent."
Odas feel say goment need to do more serious military attacks to fight di insurgents.
Anoda set believe say goment must to first tackle poverty and illiteracy first before dem go fit arrest di situtation for di region.


_115690962_bh2.png


_115690966_bh4.png


_115690964_bh3.png


_115690968_bk.png


_115690970_bk1.png


_115691410_bokoharamattackbornoricefarmersmurdervillagevictimsofdecapitation.png
 
Back
Top